Have been fighting for survival But everytime I hit the road the Men on black they all be judging wrong Yesterday I call my padi flourish To follow me to see promoter Cause the padi purkish Normally flourish na my padi Way sabi package So me and am together promoter Go call me savage I no go lie somebody say we dress like armed robbers But reason am na promoter we wan go see We no fit gam normal So I de on fake blings Flourish dress like who de receive 30mil Our face de shine like we just finish eating party meal We reach bus stop then I tell flourish make we come down Say brother make I use this chance See momsi brother for front Na there yawa for gas Instead to come down for bus stop Now we go come down for sarz But no shaking Am not a ciminal dem no fit ho me By the way most of the people way this area know me as artist I de clean I fit no de holy But I no know say flourish my padi de with Molly Damn those 2 for back come down we want to see you Just jejely waka come Nobody's gonna kill you They search me see 4 condoms in an empty wallet Oga these ones na yahoo boyz dem way never collect Flourish smile u know that feeling say Dem no fit catch me If I slap you for that smile we go still search you Na there flourish pick race Sarz say Dem no fit chase If you run faster than my leg My bullet go still catch you Yeh! Oga please this my guy is just an only child If you kill am now oloh he mama no go only cry She fit commit suicide and commit also homicide And what will be my faith cause the woman know say he de my side I ran there like one Fredrick mular dog Saw my padi flourish lying lifeless in a pool of blood These things happens everyday I no jus sit-down de guess bars All am saying is make we put head together END SARZ END SARZ, END SARZ These men de kill out best stars Just because for early age dem don begin de get cars, Bentleys and guest house, hotel and extras And them on the other hand no get money to rent house But what's our business Shay na Dem waste their major time Why e belike say young boys success con belike major crime This thing happens everyday I no jus sit-down de guess bars So all am saying is make we put head together END SARZ Have been fighting for survival (chei) But everytime I hit the road the Men on black they all be judging wrong Have been fighting for survival But everytime I hit the road the Men on black they all be judging wrong Iye!, iye!, baba o Iye!, iye!, baba o Iye!, iye!, baba o Iye!, iye!, baba o Stop there, where you de come from You be yahoo boy? Ahhhhh my face officer why you de slap me I go shot you now El corizo Gimme your phone I say may you gimme your phone Am, am coming from class sir Am a artist This way this country be now Belike say backwardness na our portion Give me my portion If this country goal na pride Shay I for de brag put Even for the football aspect na we de carry last put Now finish school download VPN start to hustle Sarz go still de bust boys Like say Dem be bubble Dem say they wan fight corruption I laugh, na prank With connection study agriculture You fit still work for bank Recession, Recession, Recession Lord no be my portion Quality facilities for the country which one de function Oh lord have mercy on politicians They don't know what they're doing All the stealings all the killings Lord I know it's their doing Oh lord have mercy Still on the arizona diet The boy is still young Lord I don't want to die yet I wan ibile everything like a reminisce Make money by any means in the presence of my enemies End sarz End sarz End sarz End sarz! End sarz! End sarz! May una end sarz nah No worry we go cordinate ourself.