Kishore Kumar Hits

2Shotz - Carry am go lyrics

Artist: 2Shotz

album: Pirated Copy


Trybe Records
2Shotz
Trybe Productions
ELDee The Don
When I dey primary five (eh-ehn?) I get one friend
He no dey to dey class, he no just send
You see, Emeka no know book but
For class everybody dey wonder how him take dey pass (ole)
One day we get lecture wey Emeka dey there
Him just dey concentrate like say him mind dey there
For where, na gimmicks, make we take no fear
The boy just dey stratеgies some skills and ideas
You don see with your two еyes dey offload your hand bag
Wey person for hand con dey find your school bag
Dey follow you dey argue, on top am dey brag
Ah-ahn na, your own no get label for the tag
Shut up my friend, how you take know?
If I finish with you, na your blood go dey flow
Bros abeg na, abeg no be so
In fact when I take the bag I no know
Thief my guy bag talk say him no know
Thief, ole, carry am go
He say na him first time, abi no be so?
Thief, ole, carry am go
When you hear "bring tyre", your eyes come clear
Thief, ole, carry am go
Carry gun, carry knife, only you, you no dey fear?
Thief, ole, carry am go
See this man sef, see you kack for office
You dey form oga, while your people them dey hiss
Na pen you dey take do magical tricks
You no dey touch money, but money go dey miss (ole)
Your five account them don full for Swiss
You dey chop, and you think say them no go notice
Wetin you dey do bad, and you know this
You see, I am smart, and you are a novice
Na true you talk, but na thief be your work
When you hear "bring tyre", make you no shock
Your job na with tie and corporate knocks
Agbada or kaftan, aso and rock
Na this wan we dey call thief with style
Chop alone and close the file
Everyday empty promises go dey pile
It is not my fault my brother, but meanwhile
Embezzled money talk say him no know
Thief, ole, carry am go
You say na your first time, abi no be so?
Thief, ole, carry am go
When you hear "bring tyre", your eyes come clear
Thief, ole, carry am go
Carry pen add digits, only you, you no dey fear?
Thief, ole, carry am go
Your song never comot but e don dey Alaba
As you sing finish them go carry am waka
E go con plenty like cloths for Yaba
E don dey go platinum, but my pocket is flatter
Na my own sweat them dey use make dough
See, this MC's thief my flow
Put my life-saving con carry am go
Bring tyre, fuel, matches, oh no
Pirate my CD talk say him no know
Thief, ole, carry am go
You say na your first time, abi no be so?
Thief, ole, carry am go
When you hear "bring tyre", your eyes come clear
Thief, ole, carry am go
Ten thousand copies only you, you no dey fear?
Thief, ole, carry am go
Carry am go
Thief, ole, carry am go (ole)
Carry am go
Thief, ole, carry am (ole)
Bring tire, carry am go
Thief, ole, carry am go
Ten thousand copies only you, you no dey fear?
Thief, ole, carry am go
Ole, ajibole

Ole, ajibole
Ole (onyoshi leya), ajibole
Ole (onyoshi leya), ajibole
Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya)
Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya)
Ole (onyoshi leya), ajibole (onyoshi leya)
Ole (onyoshi leya), ajibole
Let's dance

Поcмотреть все песни артиста

Other albums by the artist

Similar artists