(Clears throat) Snazzygrin na my name jor Mr moore Oko e don hook you Nobody, I mean nobody Chei Yeah listen, chei No put your eye for another man Ask them for butter Them fit collect your bread o So many things dey happen Wey I no understand I ask them for shoe Now dem ready take my leg o Nobody holy For this naija wey we dey Everybody na sinner For this naija wey we dey Nobody nobody holy For the naija wey we dey Everybody na sinner For this naija wey we dey So why criminal Go see criminal Go dey hala criminal So many things wey I de see E just dey tire me Olopa drop your gun Make we fight You nr fit kill me now Trynna make a living I de hustle for my self Nobody dey help person Na every man for himself Leave my dread for my head Yes I like am for myself Leave my tattoo for my skin Na me do am to myself No freedom Chei Small progress wey I dey make Dem don dey envy me Dem say Onos Don dey carry body Sometimes I de try Carry body now But e dey heavy me So no con dey try put Water for my zobo Tell me why you dey happy For another man sorrow Dem dey try bring me down But God nr gree for them Na God get power pass o Their energy level is zero Guess you know man You're welcome to the streets You're welcome to the life o Where pastor dey use special Prayers collect people wife o Na God get dey protect man No be lie now But wetin pastor securities Con dey do with rifle So many things wey dey happen I no understand I spit the truth on the mic Hope you understand o So many things wey dey happen I no understand I spit the truth on the mic Hope you understand o Chei Nobody wey holy pass o E be nobody Nobody weh holy pass o Yeahhhh eee aaaa Nobody wey holy pass o E be nobody Nobody wey holy pass o E be nobody I do this for the good life I do this at the right time Dem de ask me question Which day I go blow But I de wait for the right time Wrist watch dey my left But I dey wait for the right time Nobody knows tomorrow Only God knows the right time Somebody wey call you blood For the day time, don't be suprised E e go turn mosquito For the night life No be every body get open teeth And no be everybody You go follow open teeth Fake friends them go dey Write you for messenger Mind the way u talk to them o Dem be messenger Chei Fake friends everywhere Everywhere you go Dem sell pass mtn Dem think say dem wise Them go dey form Brother Solomon But them no know say Dem dey waka with empty head Snazzygrin na my name jor E be nobody It's a freestyle I say nobody Nobody wey holy pass Nobody holy pass I guess you know me E be nobody Shout out to Jamnaija Shout out to Ufas nation Yo mozzy wassup Shout out to bicoff