Kishore Kumar Hits

Femi Kuti - E No Good lyrics

Artist: Femi Kuti

album: Africa For Africa


E no good o
The way our leaders dey do
E no good o (e no good o)
(The way our leaders dey do e no good o)
E no good o
The way our leaders dey do
E no good o (e no good o)
(The way our leaders dey do e no good o)
Since dem make this democracy the suffer still dey increase
(E no good o the way our leaders dey do e no good o)
This our leaders no get shame their mission na to steal and steal
(E no good o the way our leaders dey do e no good o)
Dem don steal all we money wey dem and dem friends take dey rich
(E no good o the way our leaders dey do e no good o)
Dem don steal all the money wey dem suppose give us electricity
(E no good o)
Wey dem suppose give us water to drink
(E no good o)
Wey dem suppose to give us housing scheme
(E no good o)
Wey dem suppose to repair all the roads
(E no good o)
Wey dem suppose to give us good health care
(E no good o)
Wey dem suppose to pay the doctors well
(E no good o)
Wey dem suppose to pay the teachers well
(E no good o)
Wey dem suppose to pay the police well
(E no good o)
Their pikin go dey go the best fine school
(E no good o)
Their pikin go dey wear the best fine shoes
(E no good o)
Dem go dey stay the best fine fine house
(E no good o)
Their pikin go dey drive the best fine car
(E no good o)
Dem go dey travel to america
(E no good o)
E no good o
The way our leaders dey do
E no good o (e no good o)
(The way our leaders dey do e no good o)
E no good o
The way our leaders dey do
E no good o (e no good o)
(The way our leaders dey do e no good o)

Поcмотреть все песни артиста

Other albums by the artist

Similar artists