Dat kind thing na Awwwche When I was 18 I can't even buy jeans Money dey for garri I can't afford to buy beans Why my own niggas spend for d club matter They no dey date any girl if she's not called Martha Oppression dey the street na him I dey try settle You no feet be man fellow friend with tricycle They live the life of Gucci, Prada iPhone 11 If you can't afford this then you know dey their level This shit been affecting men for real If I no use her when I broke she go form for me Na the money men dey find no be love for real Keep the virgin to your self e no dey work for me Head burn like egbo way they light keep If not for hustle men for dey waka night kill They leave murdering to keyboard, they master keys Why the doors come dey open? Fraud na master key? Yes!!! All of una way dey rip una guy dey think say una wise E go clear for una eyes! You Dagbo ur guy dey feel say u be boss!!! Yes I'm marry to the money The schools don't concern me I need the Hennesy And the Hennesy deserve me Worst life we've been through Those pains we've been through There dey comot for body my guy when the money show Stingy men for club no let Janet see They keep playing with her ball, they no feet near Messi Yes I'm telling you stories from the genesis If your babe dey my car no dey jealous me Government dey fight us Rich men dey kpai us I call my guy paddy How this year go be na Titus He say na Geebe the way, I don frustrate I can't even buy my girl pant if she dey menstruate I give am site to bomb Make we ball like celebrity Na dating we go do no be celebrity I hustle for night because i no feet bill God Money drop my guy steal my Bitcoin I leave it all for God, I no feet fight for Bitcoin One day we sha rice and fall like bitcoinu Broke boy I was born in the nineteens When tontodikeh can't afford to buy her panties Then this life was really hard that's the main thing No wonder Bobrisky leave the male team E loud o Mothers come dey fear their daughter I work hard I can't afford to waste my data 12 a.m na blessing I no dey play with that time Since when my dad broke I stop to play since that time Cheiiiiiiiiiii Dat kind thing na Incase you don't know it's your boy skelvin_drg